Money

Oluwaseun Akinola
2 min readDec 14, 2021

--

Day 13

Hmmm, this thing way I wan talk about, na important thing o.

They talk say money rules the world. Most times, e be like say na true.

It dey provide for so many things, dey make possible for someone to care for dem health, dey make stomach belly full, and many other things.

When person get money, it be like say somehow things don better. More food go appear, you dey capable of taking care of some things; life no hard like before, everything dey better.

Money good, but at times, it dey make people go blind. It fit be that the person no good in the first place, and na the money they get that come show that person true colour.

You go see this person start to dey behave like say he no understand people way no dey his current level. Even these charities, hmmm, sometimes na for self righteousness. Everyone wan act like say they be good person.

They talk say money makes the world go round, asin it sabi make a difference in the world. Na truth be that. But I wan talk something before I end this one.

It dey inside the bible say if you get everything and you sabi do everything good, but you no get love, you no get anything. It dey good for all of us to love our neighbours.

Money good, but love better. So whether you get that money or life you dey search for, no forget what dey more important, and that na love💖.

--

--

Oluwaseun Akinola
Oluwaseun Akinola

Written by Oluwaseun Akinola

A writer that writes for the pleasure of writing.

No responses yet